

Anthonia, my sister, my friend
The memories no dey end When you come
Milton Keynes
Every weekend get new plans
You braid my hair,
I braid yours
Laughing from morning till night Everything just dey feel right
If I fit
press rewind
I for hold those moments one more time Because the best kind
of treasure
I know
Na the people wey make our hearts glow
Anthonia, my sister mine
Every memory still dey shine
London bridge and Christmas lights
You go always dey for my mind London city,
Christmas lights
Liverpool market cold cold nights To the mall we go dey roam
Trying outfits just for fun Bubble tea inside our hand Churros sweet
pass wey I plan
Now Queensland
call your name
Medical officer, making us proud
But I know where your heart belong
Family first all along
Back to Tunde wey love you well
Back to your babies,
I fit tell
Temi smile and Jade laugh
Na dem dey complete your path Family bond no fit break apart
Anthonia, spread your wings and fly
Queensland sky dey waiting high Till we laugh
together once more
My sister forevermore
From Milton
Keynes to
Queensland
Go shine,
my sister
Go shine